Nigeria 1 VS India 99...see the full tori ooπ
Lemme start giving you the Gists right away π
I understand that some of you people are allergic to reading stuffs π
But this one isAmazing facts about Football ⚽ mouth watery especially for football loversπ
Make I switch to pigin so that some of una go fit understand me wellπ€£
Because some of una ehhh... Amebo no be una calling π€£π
According to the tori wey dem tell us, dem say India national team tell Super Eagles say if dem do mistake score one goal say Nigeria don win, dem say if Nigeria won play ball or goal-keeper won catch ball di ball go turn to anoda thing.π
Dem say India score reach 99 goals na Samuel Okwaraji of Nigeria come strUggle score di only goal wey help Nigeria win di match and Samuel Okwaraji kpai for that match that day.π
1) Samuel Okwaraji kpai for pitch in 1989 against Angola in a World Cup qualifier wey shele for Lagos.
2) India never play FIFA Worldcup before, although dem qualify in 1950 after all di country wey dey dia Worldcup qualifiers group withdraw from di tournament, but India sef later withdraw when Worldcup won start, since then reach now dem never play Worldcup tournament so how dem and Nigeria take play match?
3) India and Nigeria no fit play Worldcup qualifiers because dem no dey the same continent, Nigeria ( Africa) while India na (Asia).
4) India play Olympic tournament four times( 1948, 1952, 1956 and 1960) that time Nigeria national team no know wetin be Olympics.π
5) India biggest win na 7-0 against Sri Lanka while Nigeria biggest lose na 7-0 against Gold coast and British Togoland in 1955 by then we still dey under oyinbo we never get our Independence.
India no dey play AFCON, so how India and Nigeria take play match my people?π€
In summary na lie dem lie give unaπ

Comments
Post a Comment